Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Lagos State Health District One (LSHD1) don start one ogbonge hospital programme on Monday for Orile Agege General Hospital to bring quick response for pregnant women, to reduce maternal and neonatal deaths.
Permanent Secretary of LSHD one, Dr Sola Pitan, clear tori pipo say di programme go make PHCs and secondary hospitals dey work together and hellep health workers sabi danger signs early.
According to W.H.O report, 2023, say 700 women dey kpai every day from preventable pregnancy wahala, almost every two minutes.
Say dis programme go train PHC workers to refer pregnant women sharp-sharp to approved hospitals wia dem go handle every complication.
Written by: News Author
child mortality healthcare training Lagos State Health District I maternal mortality
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026