By: Esther Ayoola
Ogun State Police don start investigation say, one eight-month-old pikin suffer sexual assault for one private school for Ogun State.
Di pikin mama, Gloria Umukoro ni carry di mata dey tuk, say di mata sup on Wednesday, March 18, for di same school wey she dey work.
She explain say di pikin dey under di care of di school principal while she bin dey teach lesson for class, but about 30 minutes later, di school director, Korede Afuye, return am.
Umukoro press tuk say, she first see wetness for di pikin leg, she think say na just urine, before she notice say na something else, so like dis police dey investigate di mata.