By: Esther Ayoola
Plateau State Gornment don impose 48-hour curfew for Jos North LGA afta Sunday attack for Angwan Rukuba wey kpai plenty pipo and wunjure odas.
Commissioner for Information, Rt. Hon. Joyce Lohya Ramnap naim announce am, say di curfew start from yesterday midnight March 29 and e go reach April 1, 2026.
For reaction, Governor Caleb Manasseh Mutfwang condemn di attack as “barbaric and unprovoked” and assure say security agencies dey mobilised to restore peace and gbag di pipo wey do am.
Di government tuk say di curfew dey necessary because of tragic security incident wey hapun for Gari Ya Waye community, Angwan Rukuba.