OBODO NAIJA

Tuggar Dump Foreign Affairs Job, Set Eye for Bauchi Governor Seat

todayMarch 30, 2026 3

Background
share close

Oga Minister of Foreign Affairs, Ambassador Yusuf Tuggar don resign from im position to follow im political plan to run for Bauchi State governor.

Di ministry tuk tuk, Kimiebi Ebienfa, na im dey konfamate di resignation on Monday.

Before now, report bin don show say Tuggar dey among four ministers for President Bola Tinubu cabinet wey go resign to pursue political ambition.

Even di minister media aide, Alkasim Abdulkadir, don earlier tuk say Tuggar dey prepare to contest for Bauchi governorship seat, so like dis im don resign.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app