ELECTION

33 Results / Page 1 of 4

Background

OBODO NAIJA

I Go Resign If Tinubu Lose for Rivers, FCT – Wike

Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, don vow say e go resign from im position as minister if Presido Bola Tinubu lose di 2027 presidential election for Rivers State and FCT. Wike make dis statement during meeting with leaders and members of Apo Mechanics and Traders Association for Abuja, as e say im stay for Tinubu cabinet depend on whether e fit deliver electoral victory for di Presido. […]

todayOctober 1, 2026 11

OBODO NAIJA

Baba Presido Drop Hin Mouth Odour For 2027 Opposition

For di Bad belles and  opposition, ogbonge update oh, baba, aka Jagaban, President Bola Tinubu  just land Lagos yesterday  from  holiday, incase u dey think say senior man dey sick, as senior man say  hin don ready for di 2027 race, person wey leg nor strong comot body. Na so e tell all di news tatafos for airport, comot body, comot body, energy dey fully 100 percent. Baba seyi say […]

todaySeptember 30, 2026 17

OBODO NAIJA

Wike Deny Say He Rig 2023 Election For Tinubu

FCT Minister, Nyesom Wike, don deny allegate say e rig 2023 presidential election for South-South to favor Presido Bola Tinubu against Labour Party candidate, Peter Obi. Wike tok dis one for TV siddon tok with tori pipo for Abuja, on Wednesday say dat allegate na anyhow tok wey no hold water, say na just social media gist wey dey spread. E say di election results come from strategy wey dem […]

todaySeptember 24, 2026 15

OBODO NAIJA

Federal Gornment Nor Give Me 50 Billion Naira – Seyi Makinde

Oyo State Govo, Seyi Makinde don accuse Federal Capital Territory Minister, Nyesom Wike say he dey drop banga. Makinde tok dis one on Tuesday for Makinde/Daura 2027 Presidential Town Hall meeting for Katsina, say Oyo State Gornment no receive any N50bn from di Federal Gornment, say na di state gornment use dia money take upgrade di Ladoke Akintola International Airport for Ibadan. Remember say, Wike do interview with tori pipo […]

todaySeptember 23, 2026 15

OBODO NAIJA

Wear APC Cap Or Commot Park – Esan West LGA Boss Tok

E don red yo, Okpebolo promise, na di pipo dey hear am, like dis na Esan West LGA Chairmo, Oga Blessing Ebhodaghe don order transport drivers for Edo State, say dem gat wear APC caps, cause any kpoko, di person go chop fine. Ebhodaghe give dis order on Thursday for motor park to hellep baba Govo, Monday Okpebholo, gather 2.5 million votes give Presido, Bola Tinubu for 2027 election. Di […]

todaySeptember 18, 2026 12

OBODO NAIJA

Only Six Northern Gofnors Support Tinubu For 2023 – Shettima

Vice Presido, Kashim Shettima don reveal on Wednesday say na only six out of 19 northern Gofnors support President Bola Tinubu presidential ambition for di 2023 election. Shettima talk dis one for di palace of Emir of Ilorin, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari, during di turbaning of Kwara Gofnor, AbdulRahman AbdulRazaq, as Sardauna of Ilorin Emirate. E say di tension wey follow di 2023 presidential campaign and election dey very clear, and […]

todaySeptember 17, 2026 15

OBODO NAIJA

Comot If You No Go Support APC – Samuel Danjuma Shekwolo Yarn

As 2027 general election dey come near, Kuje Area Council chairman for FCT, Samuel Danjuma Shekwolo, don threaten say e go resist residents wey wan vote against di ruling All Progressives Congress (APC). For one video wey dey circulate for social media, Shekwolo say e no go allow anybody for di council work against APC or oppose Presido Bola Tinubu second-term ambition. Di chairman point to development projects wey Presido […]

todayAugust 25, 2026 19

Lagos

Sanwo Olu Tok Say APC Dey Ready To Win Lagos For Di 2027 Election

Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, don talk say APC don ready well-well for di 2027 general election, as e dey confident say di party go carry victory for Lagos. Sanwo-Olu talk dis one on Monday after e waka go inspect APC presidential and gornorship campaign offices to see how preparation for di election dey go. Di Govo say di party campaign structure don dey set, as dem don start to dey […]

todayAugust 25, 2026 20 6

Politics

Must Read: Election Period, Hope for Some, Fear for Others

Written by: Jolayemi Olajide  For millions of Nigerians, election suppose be di time wey everybodi go join hand choose dia leaders and make way wia di country go head. But as di elders dey talk, "Water wey dem take cook beans, na im dey swallow am". Sabi pipo once tuk say, if election process start with trouble, na wahala everyone go chop. For plenty communities wey don see pepper before, […]

todayAugust 24, 2026 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds