ELECTION

28 Results / Page 1 of 4

Background

OBODO NAIJA

Only Six Northern Gofnors Support Tinubu For 2023 – Shettima

Vice Presido, Kashim Shettima don reveal on Wednesday say na only six out of 19 northern Gofnors support President Bola Tinubu presidential ambition for di 2023 election. Shettima talk dis one for di palace of Emir of Ilorin, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari, during di turbaning of Kwara Gofnor, AbdulRahman AbdulRazaq, as Sardauna of Ilorin Emirate. E say di tension wey follow di 2023 presidential campaign and election dey very clear, and […]

todaySeptember 17, 2026 8

OBODO NAIJA

Comot If You No Go Support APC – Samuel Danjuma Shekwolo Yarn

As 2027 general election dey come near, Kuje Area Council chairman for FCT, Samuel Danjuma Shekwolo, don threaten say e go resist residents wey wan vote against di ruling All Progressives Congress (APC). For one video wey dey circulate for social media, Shekwolo say e no go allow anybody for di council work against APC or oppose Presido Bola Tinubu second-term ambition. Di chairman point to development projects wey Presido […]

todayAugust 25, 2026 13

Lagos

Sanwo Olu Tok Say APC Dey Ready To Win Lagos For Di 2027 Election

Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, don talk say APC don ready well-well for di 2027 general election, as e dey confident say di party go carry victory for Lagos. Sanwo-Olu talk dis one on Monday after e waka go inspect APC presidential and gornorship campaign offices to see how preparation for di election dey go. Di Govo say di party campaign structure don dey set, as dem don start to dey […]

todayAugust 25, 2026 16 6

Politics

Must Read: Election Period, Hope for Some, Fear for Others

Written by: Jolayemi Olajide  For millions of Nigerians, election suppose be di time wey everybodi go join hand choose dia leaders and make way wia di country go head. But as di elders dey talk, "Water wey dem take cook beans, na im dey swallow am". Sabi pipo once tuk say, if election process start with trouble, na wahala everyone go chop. For plenty communities wey don see pepper before, […]

todayAugust 24, 2026 19

OBODO NAIJA

Adeleke Announce N500m Fund For Election Violence Victims

Osun State Govo, Ademola Adeleke, don make everywia stew say na automatic scholarship to university level for children and dependants of pipo wey lose dia lives during violence before di August 15 gornorship election. Adeleke make di announcement on Wednesday for Labour movement celebration rally, shortly after he collect certificate of return from INEC. He also promise say Osun State Gornment go establish N500 million Election Violence Victims Endowment Fund […]

todayAugust 20, 2026 9

National

Former Deputy Senate Presido, Omo-Agege Cross Carpet to NDC

Former Deputy Presido, of Naija Senate, Senator Ovie Omo-Agege, don leave im old party run go join di Nigeria Democratic Congress (NDC). Di big politician don also let everybody know say im wan contest for di Delta Central senatorial seat for di 2027 general elections. Omo-Agege explain say im take dis decision after beta consulting of oracles including friends and supporters. Im praise di NDC wella and thank top leaders […]

todayMay 29, 2026 20

Politics

Obi Get Green Light as NDC Zone Presidential Ticket to South

Nigeria Democratic Congress (NDC) don reserve dia 2027 presidential ticket for Southern Nigeria, and many people dey talk say dis move fit boost former Anambra State Governor, Peter Obi chance well-well. Dem make di announcement on Saturday during dia national convention wey dey happen for Abuja. Di party still confirm am for dia official X handle, as dem post say, “NDC presidential ticket don go South!” Top party big men […]

todayMay 9, 2026 27

Politics

ADC Fix Dates For Primaries

African Democratic Congress don drop full timetable for im 2026 primary election, as party members wey wan contest now don know when battle go start. For statement wey Bolaji Abdullahi release on Sunday, di party talk say sale of nomination forms go run from May 5 to May 10, 2026. Aspirants go submit their forms from May 11 to May 13, while screening go begin from May 14 to May […]

todayMay 3, 2026 26

Lagos

Ambode Throw Weight for Hamzat as Lagos 2027 Candidate

Former Lagos Governor Akinwunmi Ambode don join APC leaders to support Deputy Governor Obafemi Hamzat as consensus candidate for 2027 election. Ambode tuk dis one for im news statement on Thursday, say Hamzat don show loyalty and hard work for di party for more than 20 years. E still praise di decision and say e believe say Hamzat get di power to carry di party for Lagos. Ambode also promise […]

todayMay 1, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds