By: Esther Ayoola
Justice Yellim Bogoro of di Federal High Court in Lagos on Monday don sentence two men, Dagunduro Bunmi and Oniyide Olusegun, to 18 months jail for keeping three live pangolins, wey be protected animal.
Dem arrest di two both of di men for Iyana Ipaja, Lagos, during intelligence-led operation by Special Wildlife Office of Naija Customs.
According to report di operation, wey Assistant Comptroller of Customs A. Mani lead, naim dem take catch dem for illegally trading and possess endangered wildlife.
Justice Bogoro tuk say dem must face punishment to serve as warning to other pipo wey dey break wildlife law.