Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Nigerian Association of Resident Doctors don raise alarm on Tuesday say danger don dey increase for health workers safety for Naija.
For statement wey dia Presido, Mohammad Usman Suleiman, sign, dem say, di latest attack hapun for Olabisi Onabanjo University Teaching Hospital.
NARD condemn di act, say di attack na shocking and barbaric act wey violate human dignity and endanger doctors for work.
Dem explain say na one female house officer dem attack after dem identify am as part of team wey dey treat patient wey later kpai for Accident and Emergency unit, warning say if gornment no act fast, e fit cause bigger strike for health sector.
Written by: News Author
Colleague Attack Ogun Doctors Protest Ogun Doctors Strike Ogun Hospital Alert
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026