Ogun State Gornment don shift di inauguration of Gateway International Airport and other big projects wey dem plan for Thursday, April 2.
Dis one happen after Bola Tinubu change di date of im visit to di state.
For statement wey Special Adviser to di Governor on Government House and General Services, Babatunde Olaotan release on Wednesday, dem talk say dem don move di event.
Now, di inauguration go happen on Saturday, April 4 instead.
Gornment say dem dey prepare well to make sure say everything waka smoothly for di new date.