obodo oyinbo

UN Question Di Death Of 3 Indonesian Peacekeepers For Lebanon

todayApril 2, 2026 3

Background
share close

All 15 members for UN Security Council don condemn di wahala wey make three Indonesian UN peacekeepers kpai die for Lebanon.

Di council tok dis one for join bodi statement, say di incidents happen for UNIFIL area for south Lebanon, including two deadly explosions, as fighting dey go on along di Blue Line between Israel and Lebanon.

Dem wish di injured quick recovery, praise all UN peacekeepers wey dey risk dia life for international peace, and reaffirm say dem support UNIFIL.

Di statement no mention Israel or Hezbollah, and e no talk who dey responsible for di attacks, but di council stress say dem want make Lebanon remain sovereign, independent, and united.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app