ISRAEL

16 Results / Page 1 of 2

Background

obodo oyinbo

Israel Giv Greece 22 Items Wey Dem Thief From Dem

Israel don return 22 ancient artifacts wey dem steal from Greece, as di two country dey use di cultural exchange take make dia relationship strong well-well. Di Israel Antiquities Authority Theft Prevention Unit na dem find di stolen items, even though officials no talk how dem take see dem or how dem take carry am comot from Greece. Greek Minister of Culture, Lina Mendoni, naim receive di ancient objects for […]

todayOctober 14, 2026 6 1

obodo oyinbo

Israeli Leaders Say Pilot Try Crash Plane Wey Carry Israelis From Dubai

By : Jolayemi Olajide   Israeli leaders on Wednesday say one pilot wey dem describe as “jihadist” try to crash a flydubai plane wey carry mostly Israeli passengers, but some passengers overpower am and stop wetin fit cause big disaster. Prime Minister Benjamin Netanyahu say as di plane dey near Israel, one of di pilots stab di other pilot and apparently try to crash di plane with everybody wey dey […]

todayOctober 1, 2026 12

obodo oyinbo

Iran President Say US Pressure Don Reach Dangerous Level

By: Kofoworola Olayinka Iran Presido Masoud Pezeshkian say US pressure on Iran don reach critical and dangerous level, as e speak for India on Friday ahead of BRICS summit. Pezeshkian say heavy sanctions and economic pressure don make Iran matter worse, especially after US and Israel military attack on Iran. He say di world dey face unprecedented complexity, as di conflict don hit Iran economy wey international sanctions already weaken.

todaySeptember 11, 2026 14

obodo oyinbo

US Vice Presido JD Vance Dodge Update on Iran War

By: Mariam Ajayi US Vice President JD Vance like dis now dey dodge questions on updates of how di war between America, Israel, and Iran go end. Tatafo pipo bin block Vance, e  try to cool di matter down for White House press briefing on Thursday, con even ague say nor be war dem dey fight for Iran. Although heavy bomb-blast don dey fly between US and Iran for days, […]

todaySeptember 4, 2026 17

obodo oyinbo

Netanyahu Swear Say Iran No Go Control Any Palestinian State

By:  Mariam Ajayi Israeli Prime Minister, Benjamin Netanyahu don swear say as long as e remain Prime Minister, e no go allow any Palestinian state wey Iran dey control to happun. Netanyahu make di statement for weekend, August 23, 2026, for message wey e post on X, as argument over Palestinian statehood continue to dey hot. E say Gaza and Judea and Samaria, wey Israel dey use refer to di […]

todayAugust 24, 2026 16

obodo oyinbo

Netanyahu, Trump Meet Again As Iran War Tension Shake Their Relationship

By: Esther Daniel Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu go meet US President Donald Trump for talks at di White House on Tuesday, as both leaders try to manage issues from di Iran war wey don cause disagreement between dem. Di meeting go be dia first face-to-face discussion since di war with Iran started, as both leaders dey look for way to handle di situation. Relations between Netanyahu and Trump don […]

todayJuly 28, 2026 29

obodo oyinbo

Iran Warn US & Israel As 20 Million Pipo Gather For Khamenei Burial

Iran top negotiator don sama warning say, if US and Israel refuse to end di war as dem promise, Iran go change am for dem. Dis warning dey come as over 20 million pipo gada  for Tehran for di burial of former Supreme Leader Ali Khamenei, wey kpai follow im family members since di war start. Iran army commander self done swear say dem must revenge di blood of Ayatollah […]

todayJuly 3, 2026 21

obodo oyinbo

Middle East Peace Deal Dey Shake, Israel Resume Heavy Fight

Fresh tension don rise again for Middle East as Israel and Hezbollah exchange heavy attacks for Lebanon on Friday. According to report, di new peace deal between Iran and di United States dey shake. Tuks wey America and Iran suppose hold for Switzerland, dem don postpone am dafter Iran chief negotiator talk say dem no go shift from dia position and dat dem ready oh to take action. Di peace […]

todayJune 19, 2026 19

obodo oyinbo

Israel Capture Beaufort Castle As Di War Enter New Level For Southern Lebanon

By: Esther Ayoola Say like dis, Israel military don take over di strategic Beaufort Castle for southern Lebanon. Prime Minister Benjamin Netanyahu call dis one big “turning point” for dia attack on Hezbollah. Dat Isreal ground troops sti dey move enter deeper, inside Lebanon, pass di original boundary wey be Litani River. UK, France and Germany don criticize Israel latest military move, while Israel army sti dey tell more people […]

todayJune 1, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds