Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Iran don warn di UN Security Council say make dem nor do any “provocative action”, ahead of a scheduled vote wey dem wan take settle di wahala for strait of Hormuz.
Iranian Foreign Minister Abbas Araghchi na drop dis yarnings ahead of di Security Council suppose vote on draft resolution.
Say di resolution na to hellep create force to secure di shipping lane wey dey vital to global energy supply.
However, di planned vote dem later postpone am, and UN never give new date for am, leaving uncertainty on how di protection go take start.
Written by: Ridwan Agbomeji
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026