Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don share ogbonge update say na two separate fire gbege na im hapun for Lagos on Sunday, an all na electric na cause am.
LASEMA tuk tuk oga, Afolabi Olawale, na im dey konfamate dis mata as tori pipo bin dey touch light im frequency for dia office Lagos.
Say di first fire hapun for FESTAC Town Phase 2 when one conduit wire spark for ground floor, make di single-storey building catch fire.
Olawale say if not to say LASEMA quick Respond and Lagos State Fire and Rescue Service stop di fire from spread to top floor or enter other buildings, say na different story e for be.
Written by: Ridwan Agbomeji
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026