Di African Democratic Congress (ADC) don clear mata say di tuk dat former Senate Presido, David Mark don resign as dia party Chairmo, na big lie.
Di statement come after false tuk dey spread wetin nor good, say Mark don resign, wey di party call “insidious fabrication.”
ADC say, dem still dey united, focused, and dey ready to give Nigerians credible leadership.
Dem con sti press tuk say di fake news dey try destabilise di party ahead of 2027 elections, make supporters ignore am.