Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Nigerian sprinter Rosemary Chukwuma don start her outdoor season with beta result, wining di Battle for Bayou matas wey hapun for Louisiana.
She run 10.81 seconds (+3.1 m/s) to beat her training partner Favour Ofili and Canada’s Audrey Leduc, wey finish together for 10.93 seconds.
Chukwuma pick race for di blocks, sharp-sharp and hold her lead till di finish, even as Ofili try rush at di end.
Dis timing sef na her fastest for any condition dis 2026, her Personal Best sef na 10.88 seconds from Fayetteville 2024.
Written by: Ridwan Agbomeji
FAVOUR OFILI Nigerian sprinter Rosemary Chukwuma Sports
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026