By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment don start to prosecute 45 pipo and companies wey dey owe tax of billions of naira.
According to Attorney-General, Lawal Pedro (SAN) yarnings on Monday for Lagos, say dem don arraign di defendants for Lagos Revenue Court make dem pay di outstanding tax wey dem dey owe.
Some of di pipo wey dem list na Chidi Ajaere Emmanuel wey owe N35.4 million, Ifeanyi Uzoaru N13.5 million, and Olufunmilola Abe N30.7 million, while some companies sef dey di list.
Gornment tuk say dem dey do am to make sure everybody dey pay correct tax and so dat Lagos fit get di money to run development projects.