By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment don announce say dem go close some main roads for parts of di state to allow commissioning of major projects on Wednesday and Thursday.
Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, naim yarn dis one on Tuesday, say di temporary closures na for safety and to make sure di events run smoothly.
On Wednesday, April 8, di Opebi-Mende Link Bridge go dey commissioned from 9 a.m. to 1 p.m., wey go affect traffic for Opebi-Allen, Ikeja, and Ojota areas.
On Thursday, April 9, two events go hold, including Tolu Schools Complex, wey go affect motorists for Olodi Apapa and Ajegunle, so commuters dey advised to find alternative routes.