Lawmakers for National Assembly for one joint committee meeting on pipeline security tuk oh, say, dem dey fully support Bayo Ojulari and Tantita Security Services Nigeria Limited, say dia collabo dey bring beta result.
Chairmo of House Committee on Petroleum, Ikenga Imo Ugochinyere, say no evidence dey against Tantita, and na why dem clear di company name after dem review all petitions.
Dem explain say under Nigerian National Petroleum Company Limited, Ojulari dey give beta leadership while Tantita dey use surveillance, intelligence and quick response reduce oil theft and pipeline vandalism.
Lawmakers add say dem support di system because oil production don increase, security don improve, and if dem scatter di arrangement, e fit spoil di progress wey Nigeria dey see now.