By: Esther Ayoola
Lagos State Police Command say dom don do small Rambo arrest three suspected armed robbers for Car Wash Bus-Stop, for Idimu area.
According to Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, di operatives on routine patrol naim stop and search di suspects when dem see dem on motorcycle and dem recover machete, army camouflage cloth, four phones, power bank, small cash and Bajaj motorcycle wey dem dey use carry out robbery.
Adebisi explain say di suspects, Abdullahi Mustapha, Salisu Sannusi and Jamiu Sahidu, dey allegedly rob innocent pipo and bin dey try escape, before police intercept stop dem.
Police say investigation dey go on and Commissioner CP Tijani Fatai say di Command go continue di protection of lives and property and bring offenders to justice.