Lagos Police Command

8 Results / Page 1 of 1

Background

Lagos

Suspected Cult Boys Kpai Security Guard for Yaba

By: Yusuf Abuh Suspected cult boys don kpai one security guard  allegedly wey dem identify as Godwin for Abule Ijesha area of Yaba, Lagos, and dis one sef sup on Saturday. According to eye witness di attackers come with motor, meet am near where e dey work, shoot am for head and later use axe attack am. And dis one cause serious serious panic for di community. However, as at […]

todayAugust 3, 2026 5

Lagos

Police Gbab Three Suspected Cult Boys For Imota

By: Yusuf Abuh Lagos State Police Command don arrest three  suspect say dem be  members of Aiye cult group during intelligence operation for Imota. Inside statement by police tuk, tuk Adebisi Abinbola, Police tok say dem catch Jelili Adeyemo, di one wey dey hold guns, Bisoye Adewale and John Okeafo, and recover one Beretta pistol, one local pistol, seven Dane guns, live cartridges, stun gun, handcuffs, cutlasses and oda dangerous […]

todayJuly 23, 2026 10

Articles

LAGOS POLICE ARREST 135 SUSPECTED CULTISTS, VEHICLES WITHOUT PLATE NUMBERS

Lagos State Police Command don send strong warning to youths wey still dey see cultism as achievement instead of shame after them arrest 135 suspected cultist for different part of lagos on Monday night wey dem believe say gather because of cult initiation. Police say all di suspects wey dem parade no be people wey dem carry from dia bedroom. According to dem, na during coordinated raids for different black […]

todayJuly 8, 2026 12

Lagos

Lagos Police Kpai Jaguda Boys, Seize Hard Drugs And Weapons For AGO/FESTAC

Lagos State Police Command don go gbab five suspects wey be members of Aiye cult, say dem run di package for dia normanl  stop-and-search for Ago/Festac Bridge axis. Di Operatives gbab Emmanuel John and David Godwin inside one Toyota Camry with hard drugs, and di touch lighting of dis guys naim con lead to  police arresting Samuel Owubokiri, Adetona Seyi, and David Chigozie. Police search recover dangerous items from di […]

todayJune 30, 2026 11 1

Lagos

Lagos Police Command Mourn Dia Mehn, DCP Khan Salihu

By: Esther Ayoola Lagos State Police Command don announce di death of Deputy Commissioner of Police, Khan Salihu, wey bin dey serve as DCP wey bin dey help dem front mata for di office. For statement wey dem wrap like moimoi, wey di tuk, tuk, Abimbola Adebisi, di police praise di late senior officer say, dis na man wey sabi police work and very loyal and dat im go be […]

todayJune 16, 2026 13

Lagos

Lagos Police Command Kramp 3 Suspected Robbers, Recover Bike, Phones and Weapons

By: Esther Ayoola Lagos State Police Command say dom don do small Rambo arrest three suspected armed robbers for Car Wash Bus-Stop, for Idimu area. According to Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, di operatives on routine patrol naim stop and search di suspects when dem see dem on motorcycle and dem recover machete, army camouflage cloth, four phones, power bank, small cash and Bajaj motorcycle wey dem dey use […]

todayApril 10, 2026 25

Lagos

Lagos CP Olohundare Promise To Remove Taskforce Wey Abuse Go Office

By: Esther Ayoola Lagos State Police Commissioner, Olohundare Jimoh, don tuk now say, e no go hesitate to dissolve any task force wey personnel dey violate human rights. Jimoh tuk dis one on Saturday as e dey brief journalists for Ikeja headquarters. Dis come afta one video wey dey online show how traffic officer abuse traffic offender. But di police oga say nothing show say dem abuse or shame di […]

todayMarch 23, 2026 25

Lagos

Lagos Police Activate CCTV Centre To Rascal Jaguda Boys

By: Esther Ayoola Lagos State Police Command don activate CCTV Surveillance Centre to strengthen security for Lagos Island and nearby areas. Police Commisioner, Olohundare Jimoh, tuk say di centre go help police monitor activities beta and respond fast to any security threat. CP Olohundare Jimoh visit area for third mainland bridge, explain dat, dis one sef go make di catching of Jaguda boys go wiririwere, as dem go dey monitor […]

todayJanuary 19, 2026 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds