Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Nigeria Football Federation (NFF) don announce 36-player squad for Flamingos ahead of their second-round qualifier for FIFA U-17 Women’s World Cup for Morocco.
New head coach Akeem Busari pick five goalkeepers, 10 defenders, 13 midfielders and eight forwards as dem begin preparation for important tie against either Niger Republic or Guinea.
Di two countries go first meet for first round, and winner go come face Nigeria.
Niger Republic go host first leg of their match dis weekend, while return leg go happen for Conakry next weekend.
Winner from dat tie go later host Nigeria for second-round first leg between May 22 and 24, before Flamingos go welcome dem for return leg on May 30.
Written by: Ridwan Agbomeji
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026