obodo oyinbo

Iran and US Tuks Fail

todayApril 12, 2026 3

Background
share close

Iran and United States no reach deal to stop Middle East war, as US Vice President JD Vance talk after long talks for Islamabad, say e don drop im “final and best offer” give Tehran before e comot.

Vance say US want clear promise from Iran say dem no go build nuclear weapon, but dem never see dat commitment.

Pakistan wey host di talks urge both sides make dem respect di temporary ceasefire.

Iran state broadcaster say talks stall because of “unreasonable demands” from US, though Iran officials talk say no be something wey fit settle in one meeting after 40 days of war.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app