Lagos

South West Commissioners Gather For Lagos, Plan New Way To Solve Housing Palava

todayApril 13, 2026 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Lagos State Gornment Commissioner for Physical Planning and Urban Development, Dr. Oluyinka Olumide, don host im first meeting of South West commissioners for physical planning for Alausa, Ikeja.

Commissioners from Lagos, Ogun, Oyo, Osun, Ekiti and Ondo all join hand with DAWN Commission and South West Development Commission tuk how dem go take build strong regional integration and beta urban development.

Dem press tuk say di South West dey face issues like housing shortage, transport wahala, infrastructure gap and land use mata wey need joinbodi planning between states.

Dem sti agree on solution like regional master plan, beta coordination body, and beta transport corridor system, while praising Governor Babajide Sanwo-Olu for supporting di initiative.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app