Super Eagles coach Eric Chelle don open door for NPFL players and Nigerian players wey never play international before to join di team ahead of Unity Cup for London.
Di tournament go hapun from May 26 to May 30 for The Valley stadium wey be Charlton Athletic home ground, and Nigeria go defend di title wey dem win last year against India, Jamaica and Zimbabwe.
Chelle tuk say e wan use di competition try new players and give dem chance to show wetin dem fit do for national team.
After di tournament, regular Super Eagles stars go return for June friendly matches against Portugal and Poland.