Security operatives for Benue State don arrest seven suspects wey dem link to di kidnapping wey hapun for Otukpo Local Government Area.
Police PRO, Udeme Edet, naim dey konfamate di mata for statement wey dem release on Friday.
Recall say, di attack hapun on Wednesday when gunmen stop one Benue Links bus, rob di passengers and carry some of dem enter bush.
Police tuk say na 14 people dem kidnap, though some reports say e fit reach 17, and one person manage escape during di attack.