By: Esther Ayoola
Arsenal captain Martin Ødegaard say im still get hope say di Gunners fit win di Premier League title dis season, even after dem lose 2-1 to Manchester City for Etihad Stadium on Sunday.
Di result reduce di gap to just three points, as Manchester City sti get one match wey dem never play yet.
Ødegaard tuk to Sky Sports say Arsenal no get choice but to focus on winning all dia remaining matches.
Di Arsenal skipper believe say di title race never finish, and anything sti fit hapun as season dey go end.