Sports

Man United Perform Miracle Beat Roma 3–2

todayNovember 4, 2026 5

Background
share close

Nor be small film for Old Trafford as Manchester United, come back from 2–0  down to beat Roma 3–2 on Tuesday Champions League.

Roma first naim first call police as Matías Soulé score early for 11th minute, and before United fit clear eye, Donyell Malen fire penalty enter net to make am 2–0 enter halftime.

But as second half start, United wake up like person dem pour cold water for body, come send Matheus Cunha make e scatter Roma defense with two late goals to spoil dem party completely!

Meanwhile, for di other side of town, Bayern Munich and Barcelona no get time for story at all, dem just pack dem own opponent drag dem go corner, flog dem wetin nor gud, Bayern beat Atletico 2 kondo, while barca beat Aston villa 3 kondo.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds