By: Esther Ayoola
Lagos Waste Management Authority (LAWMA) like dis don tighten arrangement to reduce flooding as rainy season dey come for different parts of di state.
Managing Director, Dr Muyiwa Gbadegesin, yarn dis one for interview with tori pipo say dem don increase waste evacuation, especially for flood-prone and crowded areas, so dat drainage work wella.
E sti tuk say dem go enforce law against pipo wey dey dump dirt for gutter, canal, and road sides, to make sure water fit flow well during rain.
Gbadegesin add say gornment don approve repair of internal roads for Olusosun landfill, to make waste movement easy even when heavy rain dey fall.