Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don ask Senate make dem approve fresh $516.3 million loan from Deutsche Bank to take finance one road project.
Di request dey inside letter wey dem read during plenary on Thursday to Senate Presido, Godswill Akpabio.
According to di letter, di loan go fund Sections 1, Phase 1a and 1b of Sokoto–Badagry Superhighway, one major road project of about 1,000km, with 120km for current phase.
Senate Presido, Godswill Akpabio refer di letter go Committee on Local and Foreign Debts for further work after e read am.
Â