Lagos

Sanwo-Olu Dash Lagos Workers N50k To Mark May Workers Day

todayMay 1, 2026 5

Background
share close

Govo Babajide Sanwo-Olu of Lagos don announce in di spirit of workers day celebration say dem go give all public sector workers N50,000 wage award for May.

Di Lagos number one man, make dis announcement during 2026 Workers’ Day celebration wey hold for Mobolaji Johnson Arena, Onikan, Lagos.

Na di Deputy Govo, Dr Obafemi Hamzat, represent am for di event.

E tuk say di money go help reduce cost of living, and to appreciate workers unto di way dem take support di growth of Lagos State.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds