SANWO OLU

25 Results / Page 1 of 3

Background

Lagos

Sanwo-Olu Beat Chest Say Nigerians Dey Feel Jagaban

By: Mariam Ajayi Sanwo-Olu don hail Tinubu as man of the pipo, say some pipo dey look am with suspicious eyes. Senior man talk this one on Thursday for the 7th Freedom Online Annual Lecture wey hold for Ikeja, Lagos. E use the August 15 Osun election wey opposition Governor Ademola Adeleke win take give example, say Tinubu dey work day and night to bring better democracy to Nigeria.

todaySeptember 4, 2026 8

Lagos

Sanwo Olu Tok Say APC Dey Ready To Win Lagos For Di 2027 Election

Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, don talk say APC don ready well-well for di 2027 general election, as e dey confident say di party go carry victory for Lagos. Sanwo-Olu talk dis one on Monday after e waka go inspect APC presidential and gornorship campaign offices to see how preparation for di election dey go. Di Govo say di party campaign structure don dey set, as dem don start to dey […]

todayAugust 25, 2026 16 6

Lagos

NDLEA Destroy N301bn Worth Of Drugs For Lagos

By: Kofoworola Olayinka NDLEA don destroy almost 330,000 bag of drugs of different illegal drug wey worth about N301 billion for Lagos on Monday, following Federal High Court order. NDLEA Chairman Mohamed Buba Marwa say di exercise for Navy Town, Ojo, na part of effort to stop drug pipu and cut dia money supply. Di agency say di drug include cocaine, heroin, cannabis, methamphetamine, tramadol, codeine syrup and other illegal […]

todayAugust 17, 2026 14

Lagos

Lagos Water Project Don Move, New Pump Equipment Land for Iju, Adiyan

By: Esther Daniel Lagos water matter don receive fresh ginger as State Gornment on Tuesday take deliver new pumping equipment to upgrade Iju and Adiyan Waterworks. Environment Commissioner Tokunbo Wahab confirm di development through im X handle, say di equipment na part of Gofnor Sanwo-Olu administration plan to strengthen water infrastructure. Di new machines go replace old pumping systems and help improve clean water supply for millions of Lagos residents. […]

todayAugust 4, 2026 11

Lagos

Sanwo-Olu Promise Better Drainage System for Lekki Residents

Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don promise say im gornment go increase drainage work to make water flow better and reduce flooding for different parts of Lagos. Baba Govo tuk dis one on Wednesday after e inspect communities wey flood dey disturb for Chevron Drive, Ibeju-Lekki, and other areas dem. Di govo promise say government go increase dredging, excavation and drainage expansion work for di affected areas so water go […]

todayJuly 16, 2026 15

Lagos

Lagos Assembly Hail Gofnor Sanwo-Olu For Him Birthday

Nor be small doings for di Lagos State House of Assembly, betalicious owambe, say di Govo, Babajide Sanwo Olu, wey be di number one man of di state, dey mark im 61st birthday celebration. Chairmo of House Committee on Information, Strategy and Security, Hon. Stephen Ogundipe, na him tok dis one ehn, on behalf of Speaker Mudashiru Obasa, principal officers and oda lawmakers. Dem hail di senior man wetin nor […]

todayJune 25, 2026 12

Lagos

Governor Sanwo-Olu Clear Africa Film Industry Why Dem Need To Join Hand Fight Industry Oles

By: Esther Ayoola Oga govo of Naija number one business State, Babajide Sanwo-Olu, like dis, don wire call to everybody for Africa entertainment industry make dem join hand fight piracy, fight all di oles of creative work. Di Lagos number one man, yarn dis one for di 12th edition of Africa Magic Viewers’ Choice Awards wey selle for Lagos. According to Sanwo-Olu, say, if dem leave all dis Creative oles, […]

todayMay 11, 2026 18

Lagos

Sanwo-Olu Dash Lagos Workers N50k To Mark May Workers Day

Govo Babajide Sanwo-Olu of Lagos don announce in di spirit of workers day celebration say dem go give all public sector workers N50,000 wage award for May. Di Lagos number one man, make dis announcement during 2026 Workers’ Day celebration wey hold for Mobolaji Johnson Arena, Onikan, Lagos. Na di Deputy Govo, Dr Obafemi Hamzat, represent am for di event. E tuk say di money go help reduce cost of […]

todayMay 1, 2026 30

Lagos

Sanwo-Olu Beg Lawmakers Make Dem Back Am to Complete Lagos Project Dem

Govo Babajide Sanwo-Olu on Wednesday dey beg Lagos lawmakers say make dem continue to support am so dat e go finish all di projects and reforms wey dey ground before im tenure end. Im talk dis one for di 19th Executive–Legislative Parley wey hold for Eko Hotels and Suites, Lagos. Di govo emphasize say make executive and Lagos House of Assembly continue to work hand-in-hand so dem fit deliver on […]

todayApril 23, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds