By: Esther Ayoola
Oga Inspector General of Police, Tunji Disu, like dis don send order to all stations across di obodo Naija to check all dia working tools make wetin hapun for Delta nor repeat imself.
Im yan dis one during a meeting with senior officers in Abuja on Tuesday.
Disu clear im Commissioners of Police to conduct proper check of all dia tools.
Dis sef dey come afta a viral video of officers shooting a handcuffed man for Warri, and dis mata cause serious jogolo online.