Sports

Ikorodu City Burst Wikki Tourists 3-1, Celebrate 100 NPFL Goals

todayMay 6, 2026 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Ikorodu City don continue dia fine form for 2025/2026 NPFL season, beating Wikki Tourists 3-1 for Mobolaji Johnson Arena, Onikan, Lagos on Tuesday, boosting dia chance to qualify for continental football.

Salami Farouk naim start di goal scoring for di 4th minute after e meet Alfred Odinaka header, e just slot am enter net sharp-sharp.

Abayomi Ayodeji add another goal for 18th minute to double di lead for di Oga Boys.

Dat match also mark Ikorodu City 100th goal for Naija Premier Football League (NPFL).

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds