Senator Adams Oshiomhole don say Presido Bola Tinubu deserve another four years to finish di work wey e don start.
Senator Oshiomhole yarn dis one on Monday, November 9, for di APC campaign rally for Abakaliki, Ebonyi State.
E say Tinubu don pass di first hard stage of learning how to run di Gornment and e believe say another term go give di Presido more time to show di result of im plans.
E still give di minister of Works twale say e dey do e work wella and Oshiomhole really use di rally take call on pipo to support Tinubu for di 2027 election.