Lagos

Lagos Renewed Hope Group Back Tinubu For Second Term, Support Hamzat For Governor

todayMay 11, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

One political group wey call demselves, Renewed Hope Network (RHN), Lagos branch, don endorse di number one man of Naija, President Bola Tinubu, to run again for 2027 election.

Dem also support Lagos Deputy Governor, Dr Obafemi Hamzat, to run for Lagos governorship for 2027.

Di group make dis announce for prayer meeting wey dem hold for Tafawa Balewa Square for Lagos Island, wia big political mehns and women gada, including Senators Abdul’aziz Yari and Rep. James Faleke.

According to di state Govo, Babajide Sanwo-Olu, di support na to ensure korrect doings for Lagos Economy and Naija in general.

Written by: News Editor 2

Rate it

Similar posts

Lagos

Lagos Gorment Close Eko Bridge For Repairs, Give Traffic Alert

By: Esther Ayoola Di Lagos State Gornment don announce emergency closure of di outbound lane of Eko Bridge for Lagos Island. According to Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, through statement wey dem wrap like moimoi, say di closure go start on Tuesday, May 12, 2026, for safety checks and repair […]

todayMay 11, 2026 3


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds