OBODO NAIJA

Boko Haram Attack School For Borno, say dem kidnap Students

todayMay 15, 2026 3

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Nor be small gbege for borno, say jaguda boy, allegedly boko haram go kidnap Some students for Mussa Primary and Junior Secondary School for Askira-Uba Local Government Area of Borno State early Friday morning.

Sources say di attackers use motorcycles enter di community, just about 10 to 15 minutes after soldiers finish patrol and leave di area close to Sambisa Forest.

Deputy Speaker of Borno State House of Assembly, Abdullahi Askira naim konfam di attack but say details still no clear as many students reportedly run enter bush to escape.

E also note say di timing suggest say di attackers dey monitor troop movement before dem strike di school.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds