OBODO NAIJA

Police begin touchlight how Popular Businessman “Egonaejeije” take kpai inside Abuja House!

todayMay 25, 2026 6

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Police for Abuja don begin dig inside mata of how pipo kpai one big electronics businessman, Chief Godwin Chinedu Lucky Adimike, wey many people know as “Egonaejeije Na Awka-Etiti.”

The 53-year-old businessman, wey get big face for Alaba International Market for Lagos, kpai for Karu General Hospital after dem find am with heavy wound for im house for Hassan Adamu Street, Guzape district.

Dis sad level hapun after argument burst over family business money, and di mata fly for social media say na the man son stab am during the domestic fight.

Di way the senior business man take kpai shake di whole business community for Nigeria as everybody dey wait make police finish dem investigation to know exactly wetin sup.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds