By: Esther Ayoola
Zone 2 Police Command for Onikan, Lagos State, don catch nine suspects wey dey inside two big bad-gang wey work na kpake and divert goods wey pipo buy to sell.
Oga Assistant Inspector-General of Police (AIG) for di zone, Olohundare Jimoh, clear every about di mata on Monday for press briefing
Jimoh tuk say di Zone 2 Dragon Team detectives follow correct info wey original informant give dem, na im dem take do coded operation to scata di network of dis bad boys wey dey divert goods go give illegal buyers.