By: Esther Ayoola
Di Senate on Tuesday don condemn di way bad boys take pakalam (kidnap) school children and dem teachers for Oyo State.
Di Senate President, Godswill Akpabio, tuk say dis bad tin wey hapun na national tragedy and na attack on top everybody humanity.
Akpabio cry say as di country no fit protect children and teachers, dis insecurity tin fit spoil Naija future and di education system kpata-kpata.