obodo oyinbo

Trump Ready Body For NATO Summit For Turkey

todayJune 4, 2026 5

Background
share close

US Presido Donald Trump don dey ready body to attend di NATO summit inside Turkey dis July.

Dis na according to wetin Secretary of State Marco Rubio talk.

Rubio clear di air say the US still dey inside theĀ  NATO security alliance, but things gats change to tighten US and NATO.

U sabi say, dis Wahala start as European countries refuse to join hands with US and Israel to fight Iran, which make Washington pull some of dia soliders comot from Europe.

Di summit for Ankara go gather 32 countries together, and Rubio say dis fit bi di most important meeting for NATO history to fix all di issues.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds