Politics

First Lady Launch Women Support For Baba Re-election!

todayJune 4, 2026 7

Background
share close

First Lady Senator Oluremi Tinubu don launch one new political group wey dem dey call Tinubu Torchbearers (TTB) for Abuja on Wednesday June 3, to start solid mobilization for President Bola Tinubu re-election work.

Mama Tinubu charge all di APC women leaders make dem carry di “Renewed Hope Agenda” story go down to di grassroots, wards, and polling units across di country.

She yarn say women na di heartbeat of every community, and dem must stand gidigba to yarn pipo about di fine works wey di government dey do for agriculture, security, and healthcare.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds