OBODO NAIJA

Presido Tinubu Come Back Abuja After E Go Mecca

todayNovember 5, 2026 5

Background
share close

Presido Bola Ahmed Tinubu don return Abuja on Wednesday night after e spend one week for Saudi Arabia, where e go perform lesser pilgrimage, wey dem dey call Umrah, for di holy city of Makkah.

Di Airbus wey carry di Presido land for Nnamdi Azikiwe International Airport by 8:53pm, according to short statement wey State House media office release.

Chief of Staff to di Presido, Femi Gbajabiamila, Minister of Education, Minister of State for Defence, Inspector-General of Police and other top gornment officials receive am for airport.

After Tinubu complete di Umrah rites on Friday, he tell tori pipu say na only God fit decide who go lead Nigeria.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds