Presidential candidate of Nigerian Democratic Congress (NDC), Peter Obi, and im running mate, Rabiu Musa Kwankwaso, don meet residents for Cross River State ahead of di 2027 general election.
Di two former govos of Anambra and Kano States reach Cross River on Wednesday for meeting wey dem hold for inside one hotel for Calabar.
Inside di meeting, Obi promise say hin go fight corruption better style and dat hin go invest in education , health and make sure say Nigeria dey very secure.
Di meeting give Obi and Kwankwaso chance to tell di pipu wetin dem plan to do if dem enter power and solve di problems wey pipu dey face.