OBODO NAIJA

President Tinubu Send Letter Give Senate for  Marwa  to Join NDDC Board

todayJune 4, 2026 5

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Wi oga Presido, Bola Tinubu don write  Senate say  make dem look into into di appointment of Dr Zainab Marwa as member of the Niger Delta Development Commission (NDDC) governing board.

Baba Seyi put dis one for request letter give  Senate Presido, Godswill Akpabio,  am im read am out  for dia  meeting on Thursday.

Inside di letter, Tinubu  say Dr Zainab Marwa go  represent the North-East zone for the NDDC board.

He con add say dis choice follow  law wey dey ground, based on Section 2(2) of the NDDC Establishment Act.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds