By : Jolayemi Olajide
Former Senator and daughter of Baba Obasanjo, Prof. Iyabo Obasanjo, don officially watch hand comot for APC mata inside Ogun State, dat di parti leaders nor dey try, dat dem see her finish.
She wrap dis one for one letter wey she send to the state APC Chairmo, Yemi Sanusi.
U know wetin hapun, according to report oh, Madam Iyabo pull dey out after she lose di party governorship ticket for di state.
Di US-based Professor blast di consensus format wey dem take carry Senator Solomon Adeola (Yayi) put as candidate, saying di whole system na fake and e bypass party guidelines.
She yarn say even though she promise to support consensus deal, the leaders sideline and backstab her because dem no consult her before dem pick Yayi.