By : Jolayemi Olajide
Di Nigerian Army don konfam say one soldier, one local hunter and four kidnapped victims kpai during a kidnap attack wey hapun for the Capo sand-digging site in Magbon, Mowe, Ogun State, early Monday morning.
Army spokesperson, Lieutenant Colonel Appolonia Anele, naim dey clear dis mata on Tuesday say suspected kidnappers storm the site to gbab Chinese workers and engage di security operatives like say na war film.
According to her, one soldier kpai and another sustain gunshot wounds during di exchange of fire, while a local hunter wey join di operation lose im life.
Anele add say di four victims kpai during the attack as security forces continue waka to rescue those wey dem kidnap and arrest di suspects.