By : Shalom Ovie
Ukraine police boss don accuse Russia say dem dey recruit teenage Ukrainian girls to carry out attacks against Ukrainian soldiers, after dem arrest one 17-year-old girl wey link to poisoning and killing of one soldier.
For interview wey Ukrainian news outlet Cenzor.NET publish, Ivan Vyhivskyi talk say Russian agents don arrange 6 contract killings this year through Telegram, and Ukrainian authorities only manage block 1 of di plans.
He add say dem dey use messaging apps dey target young girls, promise dem money, then dey control dem from remote.
According to am, dem even dey instruct di girls make dem use dating apps find Ukrainian soldiers, and dem go still drop money for dem hand to rent apartment where the “meetings” go happen.