African Democratic Congress chieftain, Kenneth Okonkwo don criticize di party decision to pick Vice Presidential candidate from South-South for 2027 election.
Im tuk dis one for TV sit down tuk say, di move fit worsen di political marginalisation wey South-East dey face since 1999, as dem never produce Presido or Vice Presido.
Okonkwo also yarn say if ADC really choose candidate from South-South, e no go show fairness to other zones, especially South-East.
E remind everybody say ADC na party wey South-Eastern politician Ralph Nwosu start for 2005, so dem suppose balance leadership well.