obodo oyinbo

Venezuela Two Heavy Earthquake Destroy Buildings

todayJune 25, 2026 5 1 5

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Omo, na two heavy earthquake naim don hit Venezuela back-to-back, and e  scatter buildings for di capital city, Caracas.

Di country Acting Presido, Delcy Rodriguez, don declare state of emergency sharp-sharp and say dem don close airport for di mata.

US Geological Survey (USGS) talk say di first earthquake get 7.2 magnitude and na hunder ground for west of Moron community, inside di country Caribbean coast.

Just one minute afta, another bigger earthquake, wey dem dey call wet of about  7.5 magnitude con strike same area again, and di thing really shake di place go down.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds