Lagos State Gornment based on flooding don sama beta warning say dem go bring down any shop, or building wey dey block gutters flows for Ajiran, and Ikota areas sharp.
Di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, tuk dis one after im go check di gutter systems for Lekki and those areas, say na dis blockade dey make flooding dey hapun for raining season.
Wahab warn developers say, gornment no go look face or care if di person block water way wey dey cause flooding, and dat dis movement na di betament of lagos.