FLOOD

7 Results / Page 1 of 1

Background

OBODO NAIJA

Heavy Flood Don Swallow Delta High Court, Houses and Shops for Agbarho

By: Esther Daniel Heavy flood on Friday morning don cover Delta State High Court, houses and business places for Agbarho community in Ughelli North Local Gornment Area after overnight heavy rain from Thursday night . Residents say communities like Orhokpokpor, Ehwere, Ughrwughelli and Oviri suffer serious damage as flood destroy furniture, electrical appliances, food items, clothes and other valuables inside many homes. Shop owners suspend business while motorists and pedestrians […]

todayJuly 31, 2026 22

Lagos

Lagos Gornment Explain How Heavy Rain Take Wound Lagos Roads

By: Esther Daniel Lagos State Public Works Corporation don beg residents make dem get patience as di long rainy season don cause serious flood and spoil many roads and public facilities for different parts of di state. Di agency tok say di bad roads don make movement hard for motorists, commuters and other residents, but dem dey work round the clock to repair roads and make dem safe for use. […]

todayJuly 17, 2026 12

Lagos

Sanwo-Olu Promise Better Drainage System for Lekki Residents

Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don promise say im gornment go increase drainage work to make water flow better and reduce flooding for different parts of Lagos. Baba Govo tuk dis one on Wednesday after e inspect communities wey flood dey disturb for Chevron Drive, Ibeju-Lekki, and other areas dem. Di govo promise say government go increase dredging, excavation and drainage expansion work for di affected areas so water go […]

todayJuly 16, 2026 13

Lagos

Sanwo-Olu Order Gutter Cleaning To Clear Lagos Flood

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don beg residents make dem calm down after heavy rain cause ogbonge flooding for many parts of di state in di last two weeks. Gofnor Babajide Sanwo-Olu like dis don approve immediate cleaning for 28 water channels to help reduce flooding. Oga Commissioner of Environment, Tokunbo Wahab naim explain dis mata give tori pipo o Tuesday, say na heavy rain wey fall for places […]

todayJuly 1, 2026 16

Lagos

Demolition Loading As Lagos Gornment Vow To Clear Illegal Structures

Lagos State Gornment based on flooding don sama beta warning say dem go bring down any shop, or building wey dey block gutters flows for Ajiran, and Ikota areas sharp. Di Commissioner for Environment and Water Resources,  Tokunbo Wahab, tuk dis one after im go check di gutter systems for Lekki and those areas, say na dis blockade dey make flooding dey hapun for raining season. Wahab warn developers say, […]

todayJune 29, 2026 9

Uncategorized

NEC Approve ₦83bn To Fight Flood Wahala

National Economic Council (NEC) don press naij purse for neck, approve over ₦83 billion under Anticipatory Action Trust Fund, AATF, to tackle flood wahala. Di approval hapun for meeting wey Vice President Kashim Shettima chiar for State House, Abuja on Thursday. Governor Bassey Otu of Cross River naim con fry mouth afta di meeting explain say dem first propose over ₦166 billion, but NEC finally approve ₦83.2 billion. Dat dis […]

todayJune 19, 2026 9

Local

Roads Jam as Flash Floods Scatter Lagos Streets

Motorists and residents for Lagos on Tuesday get trapped for heavy traffic jam after plenty rain wey start early morning cause flash floods for many parts of di city. Di flood block business and commercial activities, and many vehicles break down for waterlogged roads, make traffic wahala worse. Areas wey suffer pass na Lagos Island, Ikoyi, Alexander Way, Dolphin Estate, Lekki, and Obalende. Others include Funsho Williams Avenue (wey dem […]

todaySeptember 9, 2025 32

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds